2019 Election: Amina Zakari new post for INEC provoke Nigeria opposition - Knock Media™

Breaking

Ads

BANNER 728X90

Tuesday, 8 January 2019

2019 Election: Amina Zakari new post for INEC provoke Nigeria opposition

Amina Zakari, di new chairman for collation/situation centre for di presidential elections. for di Independent National Electoral Commission (INEC) for Nigeria don tok say she no be di or cousin of di kontri president Muhammadu Buhari.

She tok dis one for exclusive interview wit BBC tok tok pesin Chris Ewokor.

Zakari tok say she don dey work for INEC since 2010 unda di Goodluck Jonathan administration.

She add say notin in terms of relationship dey between her and di President.

Opposition politicians begin cry foul on Thursday January 3, just afta dem hear say Amina Zakari don collect appointment as head of vote counting centre for Nigeria 2019 general election.

Zakari tok say di position no be advisory position but chairman for collation/situation centre for di presidential elections.

She follow add say if anybodi plus di leading opposition party for Nigeria elections, PDP, get any evidence say she dey do wuru-wuru for election mata, make dem bring am forward and she go tanda gidigba to defend hersef.

Professor Mahmud Yakubu, di Chairmo of INEC announce say madam Zakari go head di collation of dis Presidential election (wey go happun on 16 February), according to local tori.

Nigeria main opposition Peoples Democratic Party PDP, Oby Ezekwesili wey be Presidential candidate of opposition ACPN, Omoyele Sowore wey be Presidential candidate of opposition AAC and many oda politicians condemn di appointment say Amina Zakari dey related to President Muhammadu Buhari.

BBC Pidgin find out say na marriage between her papa and President Muhammadu Buhari elder sister wey become Amina Zakari stepmother na im make dem relate.

INEC neva tok anytin ontop di mata.
Who be Amina Zakari?

Amina Bala Zakari, na pikin of Emir of Kazaure inside Jigawa state for northwest Nigeria.

Her husband, Bala, wey don die come from Kazaure too.

58 year old Zakari, na former Acting Chairmo of INEC, wey take over from former Chairman, Attahiru Jega wen im tenure finish for 2015.

She be di first woman to chair di commission, even if na just for di main time.

She be princess for Kazaure Emirate of Jigawa State and na for Kano northwest Nigeria she complete her primary school education.

Tori be say Buhari elder sister na im marry di papa wey born Amina (wey be Emir of Kazaure) but Buhari elder sister no be her mother.

And na 23 June, 1960 na im dem born her, according to Google.

Ahmadu Bello University (ABU), Zaria na wia she obtain Bachelor of Science, Second Class Upper degree inside Pharmacy in 1980.

Na former president Goodluck Jonathan first appoint her as INEC National Electoral Commissioner before 2015 election.

She don become Senior Consultant/Chief Pharmacist wey dey work on PTF-funded health projects across Nigeria.

She once serve as Special Assistant to President Olusegun Obasanjo from 2004 to 2007.

Amina Zakari don also become chairmo of Inter-Party Advisory Council (IPAC) of INEC and chairmo of the INEC Planning Monitoring and Strategy Committee effective November 2014.

Di first time wey tok of Amina Zakari fit be Buhari sister (niece) land on July 27, 2015, wen local tori pipo Nigerian Tribune quote one supporter of then president Jonathan, Alhaji Tanko Yakassa.

But Yakassai clear di mata on September 8, 2015, inside anoda interview ontop local tori pipo Channels TV, wia him deny say Amina Zakari no get any blood relations with Buhari.

Im say some politic party dem manipulate wetin im tok.

Wetin di Presidency tok for di mata
Garba Shehu, di tok tok pesin for Nigeria president release statement say PDP just dey accuse anyhow say Zakari na relation of di Oga Buhari but all dat one na lie.

Di statement follow tok say PDP don forget say na Jonathan goment first give Zakarri work for INEC.

E follow confam say na inter-marriage join dia extended family but no be say dem be blood relation an wetin PDP dey tok na lie.

How Nigeria politicians react to Amina Zakari new appointment
"By our own understanding, by appointing Mrs. Zakari to head di collation of dis Presidential election (wey go happun on February 16), Prof. Yakubu (di INEC Chairmo) don confam say im hand no clean and im don already bow to pressure by di President office and APC to open di way for oga Buhari to succeed himsef."
- Kola Ologbondiyan wey PDP tok-tok pesin tell tori pipo.

Topics Wey Dem Resemble

No comments:

Post a Comment